Bicycle Wheel
Dem no yarn us sey,life for here na janglova,he go carry you go up,com bring you down.Sometimes,he fit cut,you com fall for ground yakata like crate of eggs,your own fit be like basket of pomatoes.
No mata how night long,dey go still break,sun go still show.No mata shege wey life show you,no go lost inside pot of sorrow wey kaikai prepare kip,
You go plan well,but life go happen,everytin go fall apart,he com be like sey you no plan at all.you go buy land,unto sey tommorow you go resell am ,use de moni guard your side.Befor you no,landgrabba don grab am wit powa,you na com de go cot everydey dey yarn grammar.
No mata how night long,dey go still break,sun go still show.No mata shege wey life show you,no go lost inside pot of sorrow wey kaikai prepare kip,
You go put moni for bank,befor you yawn,yahoo boys don clear your account.Everywhia com blur,com dey show zero,zero.You carry moni put for forex,one day everytin com crash,moni com vanish.life na bicycle wheel,na so so turn,de tin dey turn.
Life com be like sey,guy man no plan am wella.You fit buy car todey,armed robba com snatch am go.Your beta warehouse fit catch fire,everytin com turn to ashes.Your money fit still finish,wife and children com run leave you.
Life just dey turn like bicycle wheel,todey fit no fine rich tommorow,sometimes tomorrow fit com beta pass today.Old age fit resemble horror movie,he fit com look cool like Bollywood love movie.
No mata how night long,dey go still break,sun go still show.No mata shege wey life show you,no go lost inside pot of sorrow wey kaikai prepare kip.
My guy just stay tune,no go kpai yasef,no go lost.Na de one wey kpai na him lose,de one wey wey lost inside kaikai na him bad pass.Enitin fit still happen befor tommorow morning.If you stay tune to de frequency of patience.
Pipple wey old don see tire,pipple wey get sense don hiar tire,pipple wey don see and hiar tire no dey fiar enitin again.Dey don see and hiar all de shege banza promax of dis life.
If your moni finish,respect go lean like broom,if your business,friends go build fences,if sickness hold you,three weeks,everybodi don forget you.If you com kpai,afta one week.Everybodi don forget you.
De amount of moni wey you get,go detamin de amount of respect wey you go get.De kind of cloth wey you wiar go show how dem go greet you.Life be like bicycle wheel,na so so turn he dey turn.
No mata how night long,dey go still break,sun go still show.No mata shege wey life show you,no go lost inside pot of sorrow wey kaikai prepare kip,no go kpai yasef,time still dey for moon to show,if sun don waka go sleep.