This feeling wey I get for you oh
Olu.b umani on this one again
Every time I see your face
My heart dey race, I no fit control
The way you smile e dey scatter my brain
I swear down, you don make me lose control
Na you be my jara, my ginger for life
Without you baby, I no fit survive
I dey craze for you, omo!
No cure for this love wey I feel oh
I dey mad for you, on God!
You be the one wey my heart dey call
Crazy, crazy, crazy for you
Baby you know say na true
I dey lose my sense, e choke!
When you near me oh
Your touch dey make my body dey shiver
Your voice na medicine wey I need forever
I no care wetin person go talk
Na you I choose, na you I want
From Lekki to VI, I go follow you go
Mo gbe! This love e don do me finish
I dey craze for you, omo!
No cure for this love wey I feel oh
You be the one wey my heart dey call
Crazy, crazy, crazy for you
Baby you know say na true
I dey lose my sense, e choke!
When you near me oh
Crazy in love, no cap!
You don scatter my head finish
Ah ah ah! Love you forever my angel
OLUWASEGUN olu.b umani