I no fit resist
OLUWASEGUN umani
Every time wey you dey move
My heart dey dance correct
The way you dey carry yourself
E dey make my head reset
I no fit lie, I dey feel am
Deep inside my chest
Your body dey send signal
My heart dey answer yes
Your body is calling my heart
I no fit stay apart
You dey scatter my mind
E choke!
When you dey walk, when you dey talk
I dey lose control
Your vibe dey sweet pass honey
E dey touch my soul
Abeg, make you come closer
Make I tell you wetin I hold
Your body don cast spell for me
I don sell, I don fold
Your body is calling my heart
I no fit stay apart
You dey scatter my mind
On God!
OLU.b !
Your body, my heart
Wahala don start oh
I don fall!