(Intro)
In case you never know this is me again T boy.
(Chorus )
See the unbelievers wey dey criticize us, baba God make you put them to shame.
Wetin we no do them go say we do,
Baba God na you dey our side oo.2x
(Verse 1)
Them won spoiled my name, them won stain my name.
But with Almighty God my name no fit stain.
The face of this world won put me for bad place.
But me i dey pray to God, make he give me the grace.
Wetin me i no do, them go say me do.
Wetin me i no say them go say me say.
Bad belly people won see my downfall, with holy Ghost fire all of them go die one.
For inside this year me i go make am.
For inside this all of us go make am.
So anything wey dem plan, them go dey plan for their head ooo.
(Chorus)
See the unbelievers wey dey criticize us, baba God make you put them to shame.
Wetin we no do, them go say do,
Baba God na you dey our side oo.2x
(Verse2)
Baba God na you dey my side .
if you, na where me for dey
The wicked people won make i fall, but Jehovah God nor go let me fall.
Baba God na you give me the talent wey i dey use take dey feed.
Jesus Christ i thank you for all you don do for meee.
Baba moo. Oh no oh oh oh oh oh oh.
(Chorus)
See the unbelievers wey dey criticize us, baba God make you put them to shame.
Wetin we no do them go say we do,
Baba God na you dey our side oo. 2x
(Outro)
T boy is back again on the microphone
E shap na.
Oya off am my guy.