E dey burn me inside, I swear..olu.b
Baby tell me why, why you dey do me like this?
Every time I call your line, na voicemail I dey kiss
Your love na like water wey I need to quench my thirst
But you dey give me drought, e dey pain me for chest
When you withdraw your love, e be like say I dey burn
My heart dey cry for you, when you go learn?
When you don't love me, e be like fire in my body oh
I dey burn, I dey turn, omo wahala for my body oh
When you don't love me, na flames wey dey consume me
I no fit breathe, I need you here beside me
See this love na hospital, but you be the medicine
Without you here with me, I dey suffer like Edison
Your absence dey wound me pass any weapon
Bring back your affection, abeg no be question
This fire inside e dey scatter my soul
Come back make I whole, baby that na my goal
When you don't love me, e be like fire in my body oh
I dey burn, I dey turn, omo wahala for my body oh
When you don't love me, na flames wey dey consume me
I no fit breathe, I need you here beside me
Fire in my body... fire in my soul
Come back to me baby... make I whole